15
Di Meetin Wey Dem Whole For Jerusalem
Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.” Wen Paul and Banabas don argue with di pipol well-well, di church pipol kon send Paul and Banabas with some oda pipol go Jerusalem go meet di apostles and di eldas, so dat dem go ask dem about di matter. So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well. Wen dem rish Jerusalem, di whole church with di apostles and di eldas kon welkom dem, den dem tell dem evritin wey God don use dem do. But some Farisee wey don bilive Christ stand up kon sey, “E good make wi tell Gentile pipol make dem sekonsaiz and do evritin wey Moses Law tok.”
Di apostles and di eldas kon whole meetin to tok about di matter. Afta dem don argue well-well about di matter, Pita kon stand up sey, “My brodas, una know sey before-before, na mi God choose make e go prish give Gentile pipol make dem hear and bilive en word. And God, wey know wetin dey inside pipol mind, don show ensef to dem wen E give dem di Holy Spirit, just as E give us and E nor do wayo between wi and dem bikos, E make dia heart klean by faith. 10 So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head? 11 Wi bilive sey God save us thru grace wey kom from Jesus Christ, just as E do for dis Gentile pipol too.”
12 Evribody wey dey for der kon kwayet dey hear wetin Banabas and Paul dey tok and dem tell dem about di mirakles and wonders wey God use dem do among Gentile pipol. 13 Afta dem don tok finish, James ansa, “Awa brodas, make una hear wetin I won tok. 14 Pita don tell us how God first choose some pipol from Gentile wey go dey tok about am. 15 Dis tins gri with wetin di profets tok before sey:
16 “ ‘Afta all dis tins, I go kom back
and I go build David house wey don fall;
I go build am with all di san wey skata for groun
and e go strong again,
17 so evribody go kom meet God,
plus Gentile pipol wey I don koll to bi my pipol.’
God wey make all dis tins, na so E tok
18 and E know sey na so e go bi.
19 “So, I go sey make wi nor make tins hard for Gentile pipol wey just start to serve God, 20 but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood. 21 Bikos na since awa grand-grand papa dem time dem don dey prish Moses Law for di sinagog for evry Sabat Day.”
22 So di apostles, eldas and di whole church kon gri sey dem go send some men follow Paul and Banabas go Antiok. Den choose Judas, wey dem dey koll Barsabas and Silas and dem bi leaders among di brodas. 23 Na wetin dem rite for di leta, bi dis,
“From di apostles and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentile wey dey Antiok, Siria and Silisia. Wi greet una o-o! 24 Wi hear sey some pipol kom meet una sey dem kom from us, even doh wi nor send dem. Dem dey konfuse and tell una wetin go disturb una mind. 25 So all of us kon gri sey make wi choose pipol wey go follow Banabas and Paul, wey bi awa friend, kom meet una. 26 Dis men dey risk dia life, bikos of awa Oga God Jesus Christ name. 27 So wi send Judas and Silas wey go tell una all dis tins by demsef. 28 Bikos wi and di Holy Spirit nor won put heavy load for una head, so na dis small advise wi dey give una: 29 ‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”
30 So wen dem don send dem go, dem kon go Antiok and afta dem gada evribody, dem kon give dem di leta. 31 Bikos of wetin dem rite put for di leta, all di pipol happy wen dem read am out. 32 But Judas and Silas, wey bi profet, enkourage di pipol and wetin dem tok kon make di pipol heart strong. 33 Afta dem don stay der tey small, di brodas kon send dem back with peace to di pipol wey send dem kom. 34 But Silas sey e go still stay der for sometaim. 35 Paul, Banabas and odas kon still stay for Antiok dey tish and prish God word.
Paul And Banabas Separate
36 Afta some days, Paul kon tell Banabas, “Make wi go back go visit di brodas for all di town wey wi for prish God word, so dat wi go know how dem dey.” 37 Banabas won kon karry John Mark follow body, 38 but Paul sey make dem nor karry am, bikos na so e take leave dem for Pamfilia before and e nor follow dem do di work. 39 Dis matter kon kause sirious kworel, sotey dem kon separate. Banabas take Mark follow body and dem kon enter ship go Cyprus, 40 but Paul choose Silas and dem go meet di brodas and sistas kon pray make God bless dem. 41 Paul pass thru Siria and Silisia dey enkourage di pipol wey dey di church dem for der.